Wednesday, 20 June 2012

FUNNY: LETS PRAY!!! PSALM 23

at 01:29  |  1 comment

1) D lord na my shepard,i kampe

2) E make me sidon 4 where beta dey flow nd come put me next 2 stream make my body thermacool

3) E panel beat my soul come spray am white,come dey lead me dey go thru express road of righteousness becos of him name.

4) walaii if i waka pass where arm robber, 419, juju people come even join boko haram,reach valley of d shadow of death sef,liver no go fail me.Ur rod nd staff nko?Na so dem dey like backbone dey comfort me

5) U don arrange gud food on top table make i chop.c bad bello people dey look waa waa.U rub me 4 head wit vaseline intensive lotion.My cup come be like river niger dey trowey dey go.

6) True True,beta life nd mercy go dey 4low me till i quench.And i go tanda gidigba 4 d house of chineke frm lai lai to lai lai

. AMEN

Share
Posted by Unknown
About the Author

Write admin description here..

1 comment:

Blogger template Proudly Powered by Blogger.