E get this particular restaurant wey i dey chop 4 VI
E get one oyibo wey dey always come chop there too...
Any tym dis oyibo chop finish he go shout ''Hey'', so I wonder wetin dey make am shout, I decide to chop wetin d oyibo dey always chop so maybe me self go shout too...
When I reach d restaurant last wk friday, I ask wetin d man dey chop..
Dem tell me say na chicken & red wine, so I chop am, but I no shout, I collect xtra plate,but I stil no shout..
Na then I just vex ask 4 my bill.
The waiter tell me say one plate of chicken & red wine na N45,000 then d xtra plate na another N45,000.
Na then I come shout heyyyyyy! heyyyy!! heyyyy!!!
lolBY Gabchuks
0 comments: